Breaking News

Alliance for New Nigeria (ANN) Presidential candidate FELA DUROTOYE BLOWS UP: "I no dey shake table, na Nigeria I dey shake

Alliance for New Nigeria (ANN) Presidential candidate Fela Durotoye has been topping the news of recent with his controversial campaigns. He is in this presidential race to the end, and he is not giving APC or PDP a breathing space.


Read what he said below: "Make I tell una, 2019 elections no be between PDP and APC. Na between Old Nigeria (PDP & APC) and the New Nigeria (all of us new people wey don come together, come chook head for this matter).


The New Nigeria wey we go build na country where pikin of nobody fit become somebody even if im no know anybody. Make una no leave this matter for politicians. You sef chook head. I don talk sotaay say me I no be politician, I be nation builder.


You sef be nation builder. Oya na, join me, tell all your candidate dem, make we all join hand, you sef join hand, make ALL OF US build this New Nigeria together. 

Last last, some candidates go join hand (na dem be nation builder) some no go gree join (na dem be politician), but sha, we go see the pipu wey go put Nigeria first and themselves last. Me I don talk my own. I no dey shake table, na Nigeria I dey shake .



Say NO to Old Nigeria , if not, na all of us go shame pass wetin dem done do us since."


WHAT ARE YOUR THOUGHTS?


Thank you for stopping by. Kindly subscribe to our mailing list, so that you will not miss our juicy updates. Also follow us on Instagram, Twitter and Facebook via our universal handle: @nalucoolgroup.

Remain amazing. 😃



No comments